Lyta new record label: Naira Marley sign Opeyemi Babatunde Rahimto MarlianMusic months afta disagreement wit Olamide YBNL Nation

 


Lyta, wey be young Nigerian singer on Wednesday reveal say im go soon drop im next single.

Di announcement wey Lyta drop form im Instagram page land just one day afta Popular Nigerian singer, Naira Marley sign di 22 year old singer to im record label.

On Tuesday, Marley post for im Twitter page to share one picture of Lyta wit document wey appear to be a record deal, wit di caption: "Welcome to MarlianMusic Lyta."

Lyta say im dey so excited to join wetin im call im new family Marlian music and also thank Naira Marley.

Comments